Heart failure with preserved ejection fraction: present status and future directions



chop pulmonary hypertension :: Article Creator

Wetin Pipo Wit Ulcer, Diabetes, Hypertension Fit Chop And No Fit Chop During Ramadan

Man sidon wit pikin. Plate of food dey dia front and woman stand dey look dem

Wia dis foto come from, Getty Images

Article information
  • Author, Abubakar Maccido
  • Role, Reporter
  • Reporting from Kano
  • 9 March 2025

  • Ramadan na holy month wey Muslims all ova di world dey observe by fasting from sunrise to sunset.

    But if you get diabetes, high blood pressure (hypertension), or ulcer, fasting fit dey hard for you.

    Despite di health challenges, pipo wit dis kain condition always still dey try to fast during Ramadan.

    Technically, dis kain pipo dey exempted from fasting until dem get beta, even though fasting dey among di five pillars of Islam and e dey veri important to di faith.

    Di Qur'an tok clearly for verse 185 of chapter one Surah Al-Baqarah say pipo wey dey sick or dey on a journey during Ramadan fit make up di fast for anoda time - but wit proper planning, advice from doctor, and correct eating habits.

    Dr Abdulmalik Ibrahim wey dey work for Gwarzo general hospital for Kano tell BBC Pidgin say pesin fit still fast and enjoy di spiritual blessings of Ramadan even say some risk dey.

    Ulcer and fasting Man hold im bele

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Dr Ibrahim tok say ulcers dey happun wen too much acid or one infection (H. Pylori) dey wound di stomach lining. If pesin dey fast, di stomach go still dey produce acid even wen food no dey, and e fit make ulcer pain worse.

    Dr Ibrahim say di possible risks wit fasting wit ulcer include:

  • Increased acid production: Stomach go still dey release acid even wen e empty, and dis fit cause pain and irritation.
  • Complications (bleeding & perforation): If ulcer serious, fasting fit cause internal bleeding wey fit make pesin vomit blood or see black stool.
  • Heartburn & reflux: If fasting long, di acid fit come back enta chest (acid reflux) and e fit cause serious discomfort.
  • Who fit fast?
  • Pipo wey get mild ulcer and wey dey take ulcer medicine like omeprazole bifor fasting.
  • Pipo wey no get bleeding ulcer or any serious complication.
  • Who no suppose fast?
  • Pipo wey get active or bleeding ulcer.
  • Pipo wey don get ulcer perforation or dem always get serious stomach pain.
  • Dr Sa'adatu Sulaiman wey be dietitian and also dey work for Kano State Primary Healthcare Management Board tok about food wey good and bad for pipo wit health issues.

    Foods wey pesin wit ulcer fit chop for Ramadan
  • Chop soft and light food like oats, boiled yam, mashed potatoes, and rice.
  • Fruits wey no too get acid like banana, watermelon, and apple dey gentle for your stomach.
  • Cooked vegetables like spinach, carrots, and zucchini (if raw vegetables dey make your stomach vex, no chop am).
  • Probiotic food like yogurt (plain, no sugar) and kefir.
  • Start Iftar wit 2-3 dates and water, wait small, den chop light food.
  • Go for soft food like oats, boiled yam, or veggie stew (no pepper).
  • Foods wey pesin wit ulcer no fit chop for Ramadan
  • Avoid hot pepper, citrus juices (like orange juice), tomato-based sauces, and any food wey get plenty spices.
  • No chop fried and oily foods like fried yam, akara, or veri oily foods becos dem fit increase acid and bring heartburn.
  • Avoid coffee, black tea, and carbonated beverages wey fit worsen acid.
  • No chop spicy, oily, or acidic foods like orange juice, fried yam, or too much pepper.
  • Hypertension and fasting A woman checking her blood pressure

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Hypertension (high blood pressure) fit dey affected by di food wey pesin chop, water level, and stress.

    Fasting fit get good or bad effect, depending on di pesin condition.

    Possible risks
  • Dehydration fit make BP drop: If water level drop, e fit make blood pressure too low, wey fit cause dizziness or fainting.
  • Wrong food afta fasting: If pesin chop food wey get too much salt or fat afta fasting, e fit make BP go up suddenly.
  • Medication timing: Some BP medicine need correct timing to work well, fasting fit change di balance.
  • Who fit fast?
  • Pipo wey get well-controlled BP wey dey check am regularly.
  • Pipo wey dey take once-a-day BP medicine wey fit adjust to fasting time.
  • Who no suppose fast?
  • Pipo wey get serious hypertension wey never control well.
  • Pipo wey don get stroke, heart failure, or hypertensive crisis bifor.
  • Pipo wey dey use medicine wey need strict timing.
  • Foods wey pesin wit hypertension fit chop for Ramadan
  • Fresh fruits and vegetables like banana, spinach, avocado becos dem get potassium wey go help balance salt for your body.
  • Brown rice, oats, and whole wheat bread.
  • Lean protein like fish (especially fish like salmon), chicken wey no get skin, and beans.
  • Healthy fats like olive oil, nuts, and seeds.
  • Low-fat milk, yogurt, and cheese.
  • Use natural herbs and spices to make your food sweet instead of salt (e.G., garlic, ginger, turmeric).
  • Foods wey pesin wit hypertension no fit chop for Ramadan
  • Foods wey get plenty salt like canned food, pickles, processed meat (like sausage, bacon), salty snacks (like chips, crackers), and fast food.
  • Drinks wey get caffeine like coffee, tea, and energy drinks (if you take too much, e fit affect your blood pressure).
  • Alcohol fit make your blood pressure rise and affect your drugs.
  • Fried and fatty food fit make you add weight and worsen your hypertension.
  • Diabetes and fasting A man checking his sugar level

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Diabetes na one medical condition wey mean say too much sugar dey inside blood. Fasting fit come wit some risk like hypoglycemia, hyperglycemia, dehydration, or even serious wahala like hyperosmolar hyperglycemic state or diabetic ketoacidosis for pipo wey get diabetes.

    Who fit fast?

    Bifor pesin wey get diabetes go fast, e must first tok wit doctor. Di pipo wey fit fast na:

  • Pipo wey get type 2 diabetes wey dem don control well and no dey use insulin.
  • Pipo wey fit check dia blood sugar at least two times evri day.
  • Pipo wey don adjust dia medicine wit doctor advice.
  • Who no suppose fast?
  • Pipo wey get type 1 diabetes or dey always get low sugar (hypoglycemia) or DKA.
  • Pipo wey dey use insulin or strong diabetes medicine witout adjusting am.
  • Pipo wey get kidney disease, heart problem, or nerve wahala.
  • How you fit manage diabetes during Ramadan fasting

    If you get diabetes, fasting fit dey tricky, but you fit manage am well:

  • Always monitor your blood sugar level, especially wen you dey fast. If e drop too low (below 70 mg/dL) or rise too high (above 300 mg/dL), break your fast quick quick.
  • Make sure your meals contain 40–50% carbohydrates (preferably low GI foods like whole grains, whole wheat bread, brown rice, green leafy vegetables), 20–30% protein (e.G., beans, fish, chicken, or lean meat), 30–35% fat (mostly healthy fats like olive oil or avocado), and limited saturated fat to less dan 10% of your daily calories.
  • Design your meals using di Ramadan plate method: half plate for vegetables, one-quarter for protein, and one-quarter for carbohydrates.
  • Make sure you drink plenty water 8-10 glasses between Iftar and Suhoor so you no go dehydrate.
  • No chop too much sugary foods or processed carbs like white bread and rice to avoid blood sugar wahala.
  • Chop suhoor late becos skipping suhoor or eating suhoor too early fit make you experience low blood sugar (hypoglycaemia) bifor Iftar, especially wen fasting hours dey long.
  • Both Dr Ibrahim and Dr Sulaiman don give advice and some guidance wey fit help pipo wit dis kain sickness wahala for Ramadan.

    Below na di advice wey dem give;

    General ddvice for safe fasting
  • Diabetics suppose check blood sugar at least twice daily.
  • Hypertensive patients suppose check BP regularly.
  • Ulcer patients suppose watch out for pain or discomfort.
  • If you feel dizzy, weak, or confused, break your fast immediately.
  • If you get chest pain, serious headache, dey vomit blood, or see black stool, go hospital quick.
  • Consult your doctor
  • Diabetics and hypertensive pipo need to adjust medicine bifor fasting.
  • Ulcer patients fit need medicine like omeprazole bifor fasting.
  • Between Iftar and Suhoor, make sure you drink enough water to avoid dehydration.
  • Final verdict: who fit fast?
  • Diabetics: Only if dem dey control am well and dey monitor sugar level.
  • Ulcer patients: Only if di ulcer no serious and dem dey use medicine.
  • Hypertensive patients: Only if BP dey well-controlled and dem dey monitor am.
  • Another thing we de for inside dis tori




    Comments

    Popular posts from this blog

    Epoprostenol Via High-Flow Nasal Cannula Improves Severe Hypoxemia in PH - Pulmonology Advisor

    Dyspnea (Shortness of Breath): Causes, Symptoms & Treatment - my.clevelandclinic.org

    What to Expect During Pulmonary Embolism Recovery - Healthline